Wednesday 8 April 2009

wetin i dey hear say dey happen for ABSU? over 100% increase of school fees? guess wetin their excuse come be naa. "response to global recession" o men, e get wetin Nigerians no dey use make money? e tire me o. sometimes i dey ask mysef why e dey always be lyk dis for 9ja, why dem go increase fees lyk dat? if global recession na im affect the schoo, dem no know say e go affect dem the students sponsorers? dem no know say e get people wey dey sweat blood to fit get N30, 000 pay fees, talkless of N60, 000. the koko of the matter be say dem dis people dey heartless and wicked. if na lie make dem tell us how much wey dem pay for school fees for dia time. for dia time, even secondary school leaver dey fit get beta work, but dem don spoil the country so tey university graduate no dey fit see work. if person pay all dis kain money finish, him no go still get the kain quality of education wey im suppose get, and dem want mke people hapi. na God go judge dem.

Tuesday 7 April 2009

GREATEST NIGERIAN STUDENTS

GREATEST NIGERIAN STUDENTS!!!
GREAT!!!!!!
Wetin dey happen my people? i hope say una dey hold ground well. Well, my own side dey okay o. before i yarn about 9ja and dem the students wey dey inside, make i first introduce myself. na me be Tochi Mba Okereke, alias Senator Orji, Therapaddict, Schevchenko, Tochila, T boy, Oke-osisi (e plenty o), and i dey learn Electrical Electronics Engineering for University of Stress, (sorry University of Port Harcourt)...Stress wey dey for my school no be small tin o! Dem like queue ehn, e tire me o. man pikin go queue to enter motor, man pikin go queue up to do every registration, man pikin go queue up to chop...(ask people wey dey go Mama Abuja), but anyhow wey e be, i don start be say i don start, i go finish wetin i start. so my people...i fit continue o, but Kazula ( the speaker of the house of parliament of worms wey dey my bele) don pass bill make i fall in one mama put, i go yarn with una some other time. till then, make the ALUTA CONTINUA...and VICTORIA go dey ASCERTA